Na God Go Help Me
Abugbum John
Flex on the beat
E no easy for this Naija ooh
Everyday na hustle, no values
God abeg, hear me
Hmm mmm
God abeg, hear me
God abeg, hear me so
Every morning I wake up with empty belle
Pocket dry, nothing I fit sell
Light no dey, fuel don cost like gold
How man go live when life too cold
School I go, I graduate with hope
Now na trekking no work I dey cope
Dreams big, but road too rough
I strong small, but e don too tough
Mama dey pray, Papa just dey look
Siblings dey hope say I go change their book
But how I go do am wey road no clear
Government promise, but dem no dey hear
Aah God, I beg give me small from my own
From the blessing wey you don already zone
Hmm mm
I no ask for too much, I just wan survive
Hmm mmm
'Cause this suffering wan swallow my life
Hmm mmm
God, I beg hear my cry today
Make I see small light
For this my way na you be my hope when all things fail
'Cause for this Naija (Naija Naija)
Man dey almost pale
Man dey almost pale
Hmm mmm
Prices dey rise, salary no dey
Everything hard, nothing come easy
Market woman saf dey cry for road
Even farmer no fi carry in load
Politicians dey chop, dem dey smile
We dey suffer, dem dey flex for a while
Election come dem go promise heaven
After dem win, na suffering, na suffering
I don taya to dey come say I strong
Inside my heart everything don run
Night I dey cry, but I smile for day
Make nobody know weytin I dey face
Ooh God I beg, give me small from my own
From the blessing wey you don already zone
I no ask for too much, I just wan survive
'Cause this suffering wan swallow my life
God, I beg hear my cry today
Make I see small light
For this my way, na you be my hope when all things fail
'Cause for this Naija (Naija Naija)
Man dey almost pale
Hmm mmm
Man dey almost pale
Hmm mmm
If to say money dey
(Guitar)
If to say money dey, ahgo help my mama
Build small house, no go sleep alone
Help my mama make she rest small
'Cause all her life, na only struggle
God, you see me, I no be bad person
Na condition make me the reason
I beg no forget me for this race
Make I no kpai before I see this grace
Na God go help me
Na Him go run am
Even when road dark, ahgo still stand
Mmm mmm
One day e better, I still believe
But for now, God I beg
Just give me small relief



Comentarios
Envía preguntas, explicaciones y curiosidades sobre la letra
Forma parte de esta comunidad
Haz preguntas sobre idiomas, interactúa con más fans de Abugbum John y explora más allá de las letras.
Conoce a Letras AcademyRevisa nuestra guía de uso para hacer comentarios.
¿Enviar a la central de preguntas?
Tus preguntas podrán ser contestadas por profesores y alumnos de la plataforma.
Comprende mejor con esta clase: